BREAKING NEWS : Boko Haram attack Abuja? See wetin we know about capital of Nigeria latest terrorist threat




WIA DIS FOTO COME FROM,AP
Wetin we call dis foto,

Di blast, near di popular Banex plaza shopping complex in Wuse district, na sumtin wey pipo hear from many miles away and send plumes of smoke into di air.


Abuja, di capital of Nigeria seat of power never experience any oda terrorist attack since June 2014 wen Boko Haram skill at least 21 pipo, but now fear dey ground.


Pipo wey dey live for Abuja alias residents no dey comfortable afta news begin fly upandan over di weekend say Boko Haram dey plan to attack some areas inside di Federal Capital Territory.

Seven tins you fit neva sabi about Boko Haram


Tori be say one notice alias Internal Memo wey leak from Nigeria Customs service reveal say di terrorists dem don set up camps for different locations like;


Kunyam Bush along airport road off DIA Staff quarters, Robochi/Gwagwalada Forest, Kwaku Forest Kuje, Unaisha Forest in Toto Local Government Area for neighbouring Nasarawa State and Gegu Forest close to Idu Town in Kogi State north central Nigeria.


Sake of di leaked Memo, BBC Pidgin uarn wit di tok tok pesin for di Customs Joseph Attah we deny say di memo.


E say no comot from dem (NCS) and say those wey leak am dey try cause unnecessary panic for di Nigerian capital.

Di Cartoon wey Bulama do over my pikin wedding dey very unfair - Aisha Buhari


Oga Attah also tokyarn give say make Abuja pipo no fear as security pipo don step up dia game to make sure say dem protect every one.


" we dey ask Nigerians make dem disregard di content of di memo as security pipo don unite to do dia job and fight di Boko haram dem" im explain.


But Mike Ejiofor wey be security consultant for Abuja say everibodi gatz dey worry sake of dis kain information but wetin shock am pass.

N-Power shortlist 2020 programme successful candidates for second stage?


Na how dis kain very sensitive info take leak to di general public and dat e dey very important make dem investigate di mata very well.


Ejiofor say dis kain info gatz dey classified and dat thiose wey leak am dey try cause fear and anxiety for di mind of pipo wey dey live for Abuja.


Di last Boko Haram attack na bomb attack for one busy shopping district in Nigeria's capital, Abuja, wey kill at least 21 pipoe and injured 52 more for June 2014.


Di blast, near di popular Banex plaza shopping complex in Wuse district, na sumtin wey pipo hear from many miles away and send plumes of smoke into di air.

'Boko Haram don enta Lagos'

WIA DIS FOTO COME FROM,AFP
Wetin we call dis foto,

Di last Boko Haram attack na bomb attack for one busy shopping district in Nigeria's capital, Abuja, wey kill at least 21 pipoe and injured 52 more for June 2014.

Why dis Memo dey cause panic


Abuja, wey be Nigerian capital don chop different attacks from Boko Haram.


From 2011 to 2015 di terrorist group don cari out high profile bombing including attack on Police Headquarters for Abuja, di UN building.


Dem also target bus terminal for Nyanya , church for Mandala, shopping mall wey lead to death of innocent Nigerians.


Di ugly memories of those attacks na im di make plenti Abuja resident to begin to worry and fear.

Ghana fake UN awards 'scammer' go fit face fraud charges? - See what we know


E neva too tey wey security pipo dem bin enta Toto Local Government Area of Nasarawa State wia 410 members of di Darul Salam terror group surrender to Operation Whirl Stroke.


Military tok tok pesin say dem bin surrender afta dem engage dem for inside di area wey dem di hide.


Even di govnor of Nasarawa state Abdullahi Sule don cry out say Boko Haram boys dem dey hide for different mountain area for di state.

Security on red alert for Abuja


Meanwhile security operatives dem don upgrade dia operations for Abuja plus Nasarawa and Kogi state wey be neighnours to Abuja for di north central region of Nigeria to make sure say dem stop any form of attack.


For inside statement, di defence headquarters say all security agencies dey ready kampe to fight any crime.

How Boko Haram try to 'kill' Borno govnor Babagana Zulum


According to di statement, di security agencies dem di work togeda on top intelligence mata to make sure noting bad happun.


Dem also assure di public say goment di take action and dat make pipo go about dia normal business.


Nigerian police and di FCT command say dem don deploy to different areas of di capital


Di FCT police tok, tok pesin, Manza Anjuri say Abuja pipo also gatz do di following:


•Dey security conscious


•Be dia brother's keeper


•Get beta understanding of dia neighbours


•Report any suspicious movement for dia area


•Submit any security mata to dia suggestion box wey dey different location for Abuja


 Source: BBC NEWS

0 Comments

=======================TAWK.TO=============================